Lyrics Fela Kuti – Overtake Don Overtake Overtake

Overtake Don Overtake Overtake Lyrics – Fela Kuti

Singer: Fela Kuti
Title: Overtake Don Overtake Overtake

Chorus}
I get my money
Plan my plan finish
Start to go for market

Start to go for shopping
Before I reach market nko o?
Government show don enter
My plan don spoil o

Government show don enter
My plan don spoil o
Overtake don overtake overtake!
Ah! Abeg let us get down

Into another underground spiritual game
Abeg, after my “paso, paso”
You go dey help me end am with “wen”
Because dem go hear wen, yeah!

Paso, paso, paso, paso…
Wen!
When thеy want to call, eh
When they want to call, yе

When they want to call Nigerian government
Dem give am name, “Federal Military Government”
For Libya dem give am name, “Liberation Council”
For Liberia dem give am name, “Redemption Council”

For Zaire dem give am name, “Revolutionary Council”
Dem get different different names
For different different governments
But the correct name for them

Na “soldier go, soldier come”
Soldier go, soldier come!
Soldier go, soldier come
Federal Military Government

Libya Liberation Council
Liberia Redemption Council
Zaire Revolutionary Council
Soldier go, soldier come

Soldier go, soldier come
When Obasanjo and Yar’Adua
Chop belly full and go
Them put civilian friends for there

Them shout, “Second republic!”
People wey no know dey happy
People wey know them dey look
Dem baptize the civilian government

Them name am federal government
Me I know by their name
Me I call them “soldier put, soldier go”
Soldier go, soldier come!

Soldier come, soldier go!
Na so our lives for Africa dey roll
Since them say we get independence
The civilian government wey them dey

Na soldier dey protect them
When our lives roll small
E go go knock head for wall
When our lives roll small

E go go knock head for tree
When our lives roll small
E go go knock head for stone
When I see say our lives dey roll

Like one yeye ball
Wey one yeye wind
Dey blow from one yeye corner
“Kalakuta Show”

Yeye rolling!
Gaga gugu, gaga gugu!
Woko woko, woko woko!
Look the man he dey waka

Hungry dey run for him face
“Mr. Follow Follow”
Yeye rolling!
Mr. Follow Follow!

Mr. Follow Follow, make you open eye
Mr. Follow Follow, make you open sense
“Zombie o, Zombie”
Yeye rolling!

Zombie o, zombie!
Zombie no go go unless you tell am to go and stop
Attention, quick march, left turn
Right turn, about turn, quick march

Quick march, left turn, right turn
About turn, quick march, left turn
“Shuffering and Shmiling”
Yeye rolling!

Suffering and smiling!
Every day my people dey inside bus
Forty-nine sitting, ninety-nine standing
Them dey faint, them dey wake like c#ck

Every day na the same thing
“Unknown Soldier”
Yeye rolling!
Unknown soldier!

That my mama wey you kill
She is the only mother of Nigeria
Which kind injustice be this?
Wetin concern government inside?

If na unknown soldier
Them turn blue into red
Them turn pink into green
Soldier go, soldier come!

Soldier come, soldier go!
The reason suffer our suffer
He don dey show him face to us
When black man want to start business, na big wahala

Na big wahala, he go run orisirisi running
When he start the business nko? Another wahala
Another wahala, he go beg orisirisi begging
To settle wahala, na to start wahala again

To start wahala again you go fall orisirisi falling
And things don come change again
Soldier don put everybody for reverse
Na back the country take dey walk

Soldier don put everybody for reverse
Na back the country take dey walk
Soldier don put everybody for reverse
Ah, I beg, we wan change the mood of this music now

We wan inject second bass and the big conga drums
Oya! Pop!
Na from back!
If them wan to knock your head

Eh-eh, na from back o
If them wan to knock your head
Eh-eh, na from back o
If you wan to run, be running

Eh-eh, na from back o
If you wan to run, be running
Eh-eh, na from back o
If you wan to beg, be begging

Eh-eh, na from back o
If you wan to beg, be begging
Eh-eh, na from back o
If you wan to fall, be falling

Eh-eh, na from back o
If you wan to fall, be falling
Eh-eh, na from back o
If you wan to get wahala

Eh-eh, na from back o
If you wan to get wahala
I say, na from back o
If anybody wan to try to run forward

Soldier boots go kick am back
Eh-eh, na from back o
Ah! Oya, pass o and wen
Pass o, pass o, pass o, pass o…

Wen!
Ah! Oya, second bass… pop!
My friend wan come buy fan
Him dey sweat for him dey sleep for room

Him dey fall level of tree
The fan na seventy-five naira
My friend him dey follow salary
Him dey try to save and save and save

Every time he nearly buy the fan
Government go add ten naira more
Every time he nearly buy the fan
Government go start one activity

Till the fan reach two hundred naira
My friend nearly die, he never die
My friend he no wan die
Die-die no dey for him dictionary

For where? Huh…
Him dey try to save and save again
Him save for one year and six months
Inside cupboard

Under pillow
Under, under cooking pot
Inside socks
Under carpet

Him dey on his way to buy the fan
When alarm come blow
Government announce second tier
Everything come tear to pieces

Everything come expensive
Even water become expensive
Second bass, jare… pop!
Fan don become seven hundred naira

Me and my friend start to look ourselves
He remain small make my friend dey cry
Na laugh laugh he catch monkey
Na now he come understand him life

Enjoyment can never come him way
Na now him life dey go reverse
In Africa, him fatherland
One more time…

Soldier go, soldier come!
Soldier come, soldier go!
Na so Africa man life dey be
Suffer don daburu him sense

When you wear police uniform
Na to collect money for road
Abi I lie?
When you wear police uniform

Na to collect money for road
I no dey lie!
Police station don turn to bank
D.P.O. na bank manager

Police station don turn to bank
I.G. na managing director
Na big e wahala for man to waka for road at anytime
So you see, my brothers

Overtake don overtake overtake, eh-yah
Overtake don overtake overtake, eh-yah
Overtake don overtake overtake!
Eh-yah

Eh-yah
Eh-yah…
That my mama wey you kill
She is the only mother of Nigeria

Which kind injustice be this?
Wetin concern government inside?
If na unknown soldier
Them turn blue into red

Them turn pink into green
I get my money
Plan my plan finish
Start to go for market

Start to go for shopping
Before I reach market nko o?
Government show don enter
My plan don spoil o

Government show don enter
My plan don spoil o
Overtake don overtake overtake!
Find more lyrics at lyrics.jspinyin.net

You can purchase their music thru 
Amazon Music  Apple Music
Disclosure: As an Amazon Associate and an Apple Partner, we earn from qualifying purchases
Other Popular Songs:
LMac - Abgefahrener Rumäne
ephemeral - Перестрадаю

Lyrics Fela Kuti – Overtake Don Overtake Overtake

Kindly like and share our content. Please follow our site to get the latest lyrics for all songs.

We don’t provide any MP3 Download, please support the artist by purchasing their music 🙂

You can purchase their music thru 
Amazon Music  Apple Music
Disclosure: As an Amazon Associate and an Apple Partner, we earn from qualifying purchases